|

WE GO MUST THRIVE

Black pipu fine
Black pipu strong
Black pipu sabi

Ogbonge pipu wey set
We no dey gree
We no dey carry last sef

Correct pipu wey get life
Wetin be ebola, laser fever, covid
We must to survive

Oyibo carry us commot
Dem turn us to slave
For their own domot

I gbadun our vibe
We just calm down
Dey catch cruise like….

Black pipu na light
We be our own light
Wey we take dey fight

Our fear today
E no go tey
Our hustle go pay

We go survive
Na just with time
With all our strife
We go must thrive

Similar Posts