|

Africana

Africa, na you be me
I no go ever bleach my body
Your color for my body
Na my beauty

Africa, your black skin
No dey too need medicine
E no bi like oyibo skin
Wey disease dey take play ball

Africa, I don hear your history
And na correct tory
I hear the correct things you do before
Oyibo dey come your house come tour
Because better better dey that your Timbuktu house
Na so too dem dey come your egypt house
Come borrow your sense

Now you don fall
You don become small
Because of bad leaders
Religion, and many others

Africa, Abeg stand up o
We fit come back to top o
Make we come together and unite
Like a shining light

Similar Posts