|

Boss Lady

Dem tell her say her work na for kitchen and de ‘oda room ‘ only,
Dem tell her say na to born children be her duty,
Say she no fit put mouth on top matter wey be man own,
Dem put her one side,
Use am anyhow dem want,
Come chain her with veils and silence.

Small small she start loose those chains,
Veil wey she bin de cover her mouth with, she don remove am,
She don turn am into armour,
Her voice now come be like sword.
Now dem no dey only see her,
Dem de hear her too.
She don turn bosse,
She dey in charge of her life.
Her work no dey end for the ‘oda room ‘ again,
Now she don enter boardroom.

Similar Posts